in

Story 😂 Time 🤣😂🤣

Danfo wahala 

E get why I say make all these young ladies dey try keep a friendly face when them enter public bus , infact not only bus sef, anywhere join coz e get why . To dey frown face as if una want beat pesin no go ever help una, infact e no dey make anybody fear .

Inside bus wey I enter this evening , e get this bro wey been dey inside the bus , gentle looking young man , pressing his phone and even gisting with the driver .

One fine babe enter the bus later and e be like she enter the eyes of the bro and he be want talk to her small but the babe just react like w!ld lion wey never chop , she tell the guy to back off and never try to talk to her coz he’s a low l!fe person ,him no fit give her anything .

The babe embarrass the guy to the extent driver dey even tell her to calm down coz she no know him and e no good to be rude like that , she no even wait make driver talk finish , she change am for driver too , she tell driver to keep kwayet .

Next thing , the guy tell driver to stop bus and immediately driver stop am and he tell the girl to come down . The girl no gree come down , she talk say common passenger no fit tell her to come down , make the guy go buy his own bus .

Driver tell her say na the guy get the bus o , infact him get like 10 buses for road , say the guy na gentle millionaire wey like to empower people wey him know and that he just come back from America , so she need to come down coz na him be oga .

Na so the babe start to beg o , make we help her beg the guy make him no vex . The guy say nothing wey him want understand , that she is a very Stoopid girl coz she very rude , make she come down dey go with her ev!l spirit . The girl carry shame come down .

Meanwhile , in all this me I just siddan dey watch them coz na person wey don chop get strength to dey argue .

What do you think?

Newbie

Written by John

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

GIPHY App Key not set. Please check settings

    Story 😂🤣😂

    66If don’t report bad things, he will affect you too.